The Epic Fall Of a Lost Boy
My name na Sanya-Olu,I be Nigerian from Ogbomoso North Local government for Oyo State, meaning say I be pure Yoruba boy but na for Jos, Plateau State dem born me for early 2000s.
My papa and mama na business people dem dey trade food stuffs and other things. My papa get one wife before and after he marry my mumcy, hmm that kind king Solomon vibe.
We be 11 children, four from my maale side na me be her first pikin.
As I dey like three years, my dad pursue me and my mama for him house say make we dey go our hometown, Ogbomoso, sake of say he marry another wife.
Everybody follow beg am for church even the pastor but my papa no gree for anybody. Na so we comot for Jos go back Ogbomoso. Mum start dey reason way forward for us as my younger brother never reach one year that time.
Watch out for the next episodes.
Comments