Continue from episode 1
As e be like that, my mother carry every valuable things like chairs, mattress, bed, TV set, wey dey the house dash people, she follow sell some of the properties too, na why today our house never get structure, lolz, because my father swear say he no go buy us any of the things my mama sell or dash out.
We move go Ogbomoso, go dey stay for my father family house, since he no divorce my mama, na just space him want make he fit dey gbadun the new wife.
Things dey hard small, until my mother start dey travel go. It food stuffs (mostly kulikuli) dey sell, as per trader, she dey always dey I the road to make sure say we no lack anything. From Ogbomoso to Mokwa, Bida and other places for Niger State wey I no remember the names.
Her market dey sell well well, she go buy goods, sell am for 100% gain after expenses, apart from the ones wey me and my small brother dey chop on the low when she no dey house.
Our people talk say, “ better things no dey last.” Na just the plain truth of wetin sup with my me, my mother and my kid bro be that. I notice say my mother wey dey pay my school fees, buy me books and even new clothes almost every Sunday morning no fit do anything again until she call my father for Jos. I still dey small that time but, I remember say, I dey wear the best clothes among every pikin wey dey the hood, but as things change for my mama na the clothes wey she buy since na him I come dey rock, no more new clothes for ordinary Sunday service again.
My father bros and sis do meeting and they beg am make e dey send us something make we use am hold body, na so he begin dey send 2k, very shikini money. Mummy start to dey sell bread for front of house to compliment the little wey old man dey send.
I no know as this one happen, but I just realize say my mama born another pikin dis time, a girl just less than a year after my father visit us. Every body follow us celebrate the new born baby, since na she be the first girl among us nah.
The girl dey grow and my mother start dey work for rice mill from 4am to 5pm to feed us as we don increase, she dey work for building sites sometimes too, ah that woman no lazy, na very good woman, she be the definition of a virtuous woman.
Watch out for the next episodes.
Comments